Friday, 14 March 2014
On 7:50 am by Wisdom Praize No comments
Bayelsa United don take correct swagga start dia waka dis season for de Naija League as dem manage knack Sharks 1 kondo for dia house.
Walahi, de match sweet pass bread and butter for all de fans wey watch am becos de two clubs follow diasef tap beta soccer.
Sharks been no wan open dis yarns at all for Bayelsa United, as de kain ball wey dem play no reach make dem lose de match.
|
Foma 3SC skippo, Mutiu Adegoke na hin kon be de wicked man wey score de gol wey wound Sharks for de game.
Sharks try well well make dem ekwalise for de mortuary time, but Bayelsa United no gree for dem and naso de match take kpai.
Warri Wolves also waya Elkanemi Warriors 1 zero for de match wery shelle for Warri.
Sabee strika, Musa Najere na hin score de gol wey Warri Wolves take win de match for de 71st minute.
Elkanemi Warriors even see beta chance wey dem suppose take ekwalise for de 85th minute, but Warri Wolves golkipa, Odah no gree make de ball enta net.
De main katakata match wey shelle for Akure na 0-0 as Enyimba no gree make Sunshine Stars bilala dem today.
E don tey wey Sunshine Stars dey do Enyimba gragra for dia house, but Enyimba do dem shege today for Akure.
Na Thursday Naija League results be dis
Sunshine Stars 0-0 Enyimba
Warri Wolves 1-0 Elkanemi-Warriors
Bayelsa United 1-0 Sharks
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
Search
Popular Posts
-
Host communities to the multi billion naira SPDC E.A oil field have threatened to shut down operations at the facilities in protest over wh...
-
Police declare Agip Surveillance contractor wanted over kidnap of Five Dredging workers The Bayelsa Police Command yesterday declare a 3...
-
The Police in Bayelsa on Tuesday said arrested six suspected kidnappers, who allegedly abducted a woman in Southern Ijaw Local Government Ar...
-
Bayelsa State Government has asked an Abuja Federal High Court to order the Economic and Financial Crimes Commission to immediately remit to...
-
Yenagoa-No fewer than 100 Councillors from Bayelsa State, traveling to Abuja for a seminar were, Sunday, reportedly arrested by security ope...
-
The Bayelsa Government on Tuesday denied media reports that it had filed a suit against the Economic and Financial Crimes Commission (EFC...
Recent Posts
Blog Archive
-
►
2017
(2)
- ► August 2017 (1)
- ► April 2017 (1)
-
►
2016
(2)
- ► December 2016 (1)
- ► September 2016 (1)
-
►
2015
(1)
- ► December 2015 (1)
-
▼
2014
(14)
- ► August 2014 (4)
- ▼ March 2014 (9)
-
►
2013
(10)
- ► September 2013 (3)
- ► August 2013 (1)
- ► February 2013 (2)
- ► January 2013 (4)
-
►
2011
(30)
- ► October 2011 (3)
- ► April 2011 (9)
- ► March 2011 (3)
- ► February 2011 (7)
- ► January 2011 (7)
-
►
2010
(12)
- ► December 2010 (2)
- ► November 2010 (9)
- ► September 2010 (1)
0 Comments:
Post a Comment